The Bombing

23 14 6
                                    

“Ebi! Go inside di house! Quick!” Fiona run to me, di kind speeding wey she take enter di house wit me shock me. Na only—quick, quick. I hear for wetin she tok, until I hear thunder sound wey fit to block my ear. I look back, Fiona run for wia I dey, quick to hol me. Na bomb again, di bombing sound no dey new to me but dis time, di bombing dey come near and near. 

“Fiona!” Fear catch me, I dey fraid' to lose my big sister but we run quick for inside our house. I look Fiona as we reach enter inside, I sabi dat look. E mean say, make we no tell Papa and Mama wetin juss happen as dem warn us say make we no go out. Now—I no feel safe anymore like before because di bombing dey near our house too much. 

OGA SOJA Where stories live. Discover now