ACT TWO SCENE NINE & TEN

1 0 0
                                    

[They arrived at her car parked outside his house and he yelled at the gateman Mamud to open the gate for her to go out.]

JOHNSON: Mamud!

MAMUD:  Oga!

JOHNSON: Please open the gate fot my friend

MAMUD:  Yes sir.

[They bade farewell to each other as she drove off and Mamud locked the gates behind.]

 

 

ACT TWO SCENE TEN

[Mamud is seen sitting and thinking, mostly soliloquising about problems known to him when Abigail walked in.]

ABIGAIL:  Mamud the thinker of life. Why you sit down dey think like person when get family issues?

MAMUD:  En this Happy-Girl, ki bani. Leave me alone. Me and you, ba wahala kuma. 

ABIGAIL:  I no come buy wahala. I just dey concerned as I see dey look like suya when no gree done.

MAMUD:  Kai da wawa’ne! [He insulted] As your mouth open reach you no dey see as that oga upcoming girlfriend dey do around oga? When e just reach out time madam to come house, she go jas comot. Akwai damoa walahin! [He reported]

ABIGAIL:  Anyways, no be lie you dey talk, this go make am the 7th time this month when small aunty dey reach here comot before big aunty go come house.

MAMUD:  I smell something fishy.

ABIGAIL:  How you no go smell fish. Na So so food you dey smell. Aije bai gbe e o! No let food go kill you o!

MAMUD:  Food no go fit kill me walahin. [He protested with some Hausa gibberish]. Focus on the issue on ground. You dey look me less less. If not for the condition of things I for dey Aso Rock dey rock things. Allah ya tai make mu lafia, walahin ta lahin!

ABIGAIL:  Anyways, na them come know o. E no concern me. Whether small aunty come do morning service and big aunty come do evening service na them know. Na only one oga give ring to.

[Suddenly they realised that Ebanehita was behind them as she had walked into the compound through the small gate. They were surprised and obviously cowering in fear.]

EBANEHITA:  So this is what you guys do when you are less busy eh? You gossip. Oya! Abigail return to your task. [She ordered Abigail and then faced Mamud] This is how you secure the house eh? I just walked in on your little chit chat and you did not even notice me in broad day light, Mamud!.

MAMUD:  [murmuring in Hausa gibberish] Madam, that happy-girl carry my attention go where I nor know. I even know when you take enter, but I no just wan talk.

EBANEHITA:  If you know what is good for you, better behave o.  Focus.

[She advised and walked into the house]

 

[Mamud complained in Hausa before checking the gates and moving into his abode.]

Love SwingWhere stories live. Discover now