ACT FIVE SCENE ELEVEN

2 0 0
                                    

[Abigail ran towards Mamud’s post to break the information she had heard.]

ABIGAIL:  Mamud! Mamud!

MAMUD:  Menene?! [He came out from the room to answer her] Why you dey shout like person when Esaj fowl dey pursue?

ABIGAIL:  If na that one no be good thing? Fire don climb mountain.

MAMUD:  Who put the fire there?

ABIGAIL:  If you ask me, na who I go ask?

MAMUD:  So you no ask who put fire for mountain then you pasa ran su gudu come my post dey drop the news, Madam Loudspeaker.  Sanu!

ABIGAIL:  [She hissed and continued to relay the information anyway.] I hear say police dey find Oga Johnson and big aunty.

MAMUD:  Happy-girl! Talk truth!

ABIGAIL:  True.

MAMUD:  lai lai ilalai! Weytin dem say e happen?

ABIGAIL:  I never know the full story yet, but e dey related to murder.

MAMUD : Which person mother? Oga mother or big aunty mother?

ABIGAIL:  See the reason why you suppose go school? Bottle water! Them say Oga and big aunty kill person.

MAMUD:  Toru’uba! Kai kai kai kia kai! Abubuwan al'ajabi ba za su ƙare ba! (Wonders will never end!). How you take hear am?

ABIGAIL:  See you! I go sit down for house, information, news go dey reach me for where I dey. [She bragged and began to walk away]. Later o.

MAMUD:  Kai! Ina za ki je? (You! Where are you going to?)

ABIGAIL:  I don commot dey go arrange my things just in case of incasity.

MAMUD:  [He looked stunned and pondered a little about the news] Allah yasa mu dace damoa wanan!(God will see us through this problem.)

[Light Fades out on him into the sky above]

Love SwingWhere stories live. Discover now