ACT FOUR SCENE SEVEN

0 0 0
                                    

[Back to present]

[Light Bulb is on his knees pleading earnestly with Lala who still remained partially concealed in the corner of the room.]

LIGHT BULB:  Forgive me lah lah doh reh mih. Abeg, merciful for me. E don tey when thief dey hungry me. Abeg, merciful.

PLASTIC:  See prodigal son when no dey return house. Electricity don dey finish abi nepa don carry am waka?!

LALA:  Akpakpa!* Akpakpa na that insect when dey cling to pikin when say e stubborn. E don tey when the Akpakpa settle down for your head.

LIGHT BULB:  Oga Lala, merciful for me.

LALA:  You of all people know the sacraments and sacrilegious for this church. Your offense na death sentence.

LIGHT BULB:  Ah! Oga Lala abeg merciful.

LALA:  But as you dey here so, nobody go harm you yet because na sanctified ground you dey stand.

LIGHT BULB:  Oga na devil work. Merciful.

LALA:  From today, I don excommunicate you from the church. Dey run for your life.  The 12  Apostles don receive order to eliminate you 2 hours from now.

PLASTIC:  Before I count reach 2, borrow leg!

[Light Bulb took to his heels knowing vehemently the consequences of his actions.]

LALA:  Plastic!

PLASTIC:  lah lah doh reh mih.!

LALA:  Carry the offering go drop for altar.

PLASTIC:  Yes boss

[He carried the bag of money and exits the scene.]

 

[Light fades out on Lala who shook the lit cigarette intermittently.]

Love SwingWhere stories live. Discover now